Pages

One Lagos Fiesta

One Lagos Fiesta

Wednesday 13 June 2012

WAFFI THINGS

I had published this piece long ago on my Facebook page. Just sharing with you....

My name is Ali Baba... I yam hey Waffarian.

I was talking with some guys in Warri this weekend. And the Boko Haram matter came up. We talked and argued on this issue for a while.

Then, Jolomi, asked us to hear him out. I was laughing all through his contribution. Maybe, I shouldn't have.

"Make I year wodu! Boko. BoKo. Dem be willi willi? If dem see person bless dem with koboko then go VAA!


No be party wey fawol no fit attend na hin krokroach dey dance bugallo & backslide? Dem see olele president na him cause am. If na wen dat kpians OBJ dey who born Boko with "let's dialogue"? Dem 4 don borrow leg take dialogue with speed! Dem chop winch?

Dia fada yansh! Dem no reach o!

As our guys meean reach, when doz deaf & dumb soja wey no get rank come Odi for Bayelsa, even goat bale! When OBJ, dat crase pack all d whole soja wey no know which battalion dem dey sef come area, d town echo na! So tey pikin wey him mama carry for back dey beg him mama make she drop am so him go fit take offfff welllllll!

Na 2day? Boko guys know who them dey send go general market like say them dey play WHOT! I sure say OBj still get the gsm number of those Soja wey come Odi. Make Goodluck control OBJ, to connect those guys, Boko go humble. Body go phone them.

Abegi, no even bring bomb level. Osama Osama, when he see the shooting and bombing, he aware na. Why him no wait? Those boys wey dey watch RAMBO I, II, III as homework... Leff matter o! Boko dey preach violence... OBJ na the Pope of violence... Person wey inspire Timaya 2 sing Dem don Kill dem mama? Dem dey learn!

Una dey here dey shout boko! boko!! Useless tory wey dey make cold beer warm!

May we talk another thing. I take God beg una.

PS... Just before you start to think Jolomi is a never do well, pls note, Jolomi passed his MOCK exams. He is a SUPPOSE FINISH of Urhobo College, Govt College, Ughelli, Unity School, Agbarho, Essi College, Hussey College (twice) and currently a senio lecturer at PTI (motor park)

14 comments:

  1. Hahahahhahaa Ali baba oooo ! Finally sha me, I second him arguement. Jolomi make serious point for the mata. *time to stand out now, and be OutStanding* @chiomaEN.

    ReplyDelete
  2. ppl don pack all d comment go twitter dis naa d place joooo...I love Jolomi

    ReplyDelete
  3. nice one bros.... we wait to hear from jolomi again.. @lordribey

    ReplyDelete
  4. Nice one, GEJ needs to employ Jolomi as Special Assistant on all issues involving Boko

    ReplyDelete
  5. Brosi eee, Jolomi don buss my belle with laff. Abeg, e no go bad if we fit dey read Jolomi updates on current issues weekly. I no go mind hear im side for dis 'I bribe, u collect' matter!

    ReplyDelete
  6. Baba1 u come the chew the warri pass us wey dey the abia ooO......make Itseke's nor hear abT Jolomi ooooO na dem get the town oo their senior bro naim dey run d state oo

    ReplyDelete
  7. Jolomi don talk true.....

    I so enjoyed reading this, let me go and read some more posts!

    ReplyDelete
  8. Omg!!! Laff don finish me ooooooo

    ReplyDelete
  9. "Deaf and dumb soldiers o" bros, you posted this on my birthday. I'm waiting to see someone I'm supposed to be very angry with and you're spoiling my 'bone-face'. Welldone abeg. And for the record, you're following me without my even asking.
    @hartng. d

    ReplyDelete
  10. Please we want more of Jolomi updates. Truly, GEJ should employ him to be his special adviser on Boko matters. Seiously. GEJ dey fall our hand.

    ReplyDelete
  11. Nice One Boss...Just discovered Here so much Good stuff abeg i'm off t o read others jare!!!

    ReplyDelete
  12. Jolomi jolomi. No worry i go tell GEJ to give him the appointment

    ReplyDelete
  13. Jolomi jolomi. No worry i go tell GEJ to give him the appointment

    ReplyDelete